Connect with us

Politics

Buhari visit Bamako Mali: How Nigeria President Muhammadu Buhari first trip abroad since coronavirus pandemic go be

Published

on

Buhari in Mali

President Muhammadu Buhari of Nigeria wear facemask for di first time in public wen e arrive di Malian capital Bamako on Thursday afternoon for one-day tok-visit.

Di president visit dey follow toks wit former Nigerian President Goodluck Jonathan, wey be one of di Ecowas mediators wey travel to Mali to go settle mata.

Some West African leaders, like Nigerien President Mahamadou Issoufou, don agree to meet for Mali for talks to settle di fight-fight between Mali President Boubacar Keita and di opposition.

Ghanaian President Nana Akufo Addo and Cote d’Ivoire’s Alassane Ouattara suppose dey to attend di toks.

Buhari in Mali

Garba Shehu, di special assistant to President Buhari, tell BBC say di ECOWAS leaders wan go hold toks wit di Malian side afta former Nigerian President Goodluck Jonathan delegation no gree find solution to di crisis.

He tok say di presence of di leaders fit help solve di crisis- “perhaps dia status as di West African leaders go make dem listen to dem and ensure peace for Mali”.

Buhari da shugabanni

Dis na di first time wey Nigerian President Muhammadu Buhari go comot from Nigeria since dem don close di kontri border due to coronavirus pandemic.

In di past citizens don complain say about di president travels upandan.

Copyright © FastNews Nigeria